Posts

Showing posts with the label LIFE AND STYLE

Oga Peter Obi don talk say he no go fit dey celebrate he birthday inside this yamayama Nigeria wey we dey today.

Image
Senior man, Oga Peter Obi don talk say he no go fit dey celebrate he birthday inside this yamayama Nigeria wey we dey today.  He say make nobody drink or chop meat because of he birthday, he also say make nobody send am gift, instead carry that money and gift go donate am for hospital,  orphanage, poor people wey dey your area or if you like, you fit go donate am to IDP. Senior man say plenty boku people dey die everyday inside we country,  no be time to celebrate birthday we dey so. He say we go celebrate well inside our New Nigeria when we don finally collect our country back from the tif tif people. Incoming Presido say make una carry that una  Dorime go give poor, sick and hungry people. Una doh oooo!