AGBOOLA AJAYI WAN LEAVE PDP DIS WEEK
August 4, 2020
BY ORIH MICHAEL CHINAEMEREM
tori wey dey reach our side from our tatafo people dey try clear us say, e bi like say Ondo State Deputy Governor, Mr Agboola Ajayi, wan migrate comot for Peoples Democratic Party PDP.
As Di matter bi, e bi like say na dis week oga Agboola Ajayi wan do Di migration.
Una remember say Oga Agboola Ajayi, bin dey All Progressives Congress APC, before him later migrate go PDP for June.
meanwhile as Di matter bi, e bi like say Oga Agboola Ajayi don nearly finish work ontop as him wan take migrate.
Di Tori bi say, na Zenith Labour Party him dey migrate go and as e dey hot, e bi like say na him go bi Di point man for Zenith Labour Party for Di governorship election.
Tatafo Yan us say Di oga dem at Di top for Zenith Labour Party don already finish work ontop as dem wan take give Independent National Electoral Commission oga Ajayi name as their person for governorship election wey go soon happen for ondo state.
As e bi so, oga Ajayi go first need to go him ward, go clear dem say him no be PDP person again before him fit to join Zenith Labour Party.
MeanWhile the state Publicity Secretary for Zenith Labour Party, Mr Felix Olatunde, don talk, say as di Tori bi, na so e go happen period.
Copyright (c) 2020 EAGLEHEDGE MULTIMEDIA COMPANY LIMITED.
For Advert Placement Please call 09012543471
08033207022.
Na wa ooooo
ReplyDeletePolitical prostitute
Wetin we no go see for naija
ReplyDeleteNa him sabi
ReplyDelete