MINISTER FOR TRANSPORTATION WAN USE NAIJA BORROW MONEY
MINISTER FOR TRANSPORTATION WAN USE NAIJA BORROW MONEY
BY PRINCESS EIGBOKHAN ORIH.
Oga for di chairman ad hoc committe on trities and protocol oga ossai ossai don draw the ear of oga minister for transportation bro Amechi to the percentage for treaties wey Amechi sign for China on our behind as Nigeria people.
Ossai ossai yah say he no talk say Amechi corrupt ooo but dey need to ask ministry of finance how them take come about the coma, of different percentages wey no make sense. Ossai ossai say how Amechi go take will di sovereignty of we country nijia to China .
Ossai ossai say he believe say that coma for the document wey Amechi sign with China no dey inside the one wey Amechi submit give house of rep. Wey dem approved because no man wey hin sense correct go agree to sign say if you borrow me money if after sometimes I no pay den you fit carry our country away.
Nigerian leaders what is the color of your sense.
As our leaders dey borrow to buy car, borrow to build roads, borrow to built schools borrow to do everything I beg make una Also borrow to buy brain biko.
After all these observation wey oga ossai ossai don yah give uncle Amechi for committe village meeting.
Oga Amechi look all of us for eye with him two korokoro eyes lie give us say he no know say that coma to give China we country or anything wen China go want collect from us once we no fit pay back the loan of 5.3 billion dollars wey nijia wan borrowed from China dey inside the document wey him sign.
I beg my country people make we ask bros Amechi whether him be dey sleep wey he dey sign nijia future away. Who do us this oooooo who do us this.
OK listen by yourself make you no talk say na me dey sugar cane the matter.
Jesusssssss
Bros chissss I beg just keep quiet there. Who you dey tell this fat lie to, man na god how you take think that kind thinking. Ehhh you think say Chinese people dey go Church like us or you think say them get Church mind even you bros Amachi you wey still dey dosh enter Church you use Church mind so?
So nijia wey get crude oil na ni you want make China to collect las las after we no fit pay back the loan now.
If you tell nija people say since this administration don cone power say she don pay the debts wey dey ground before?
No be only borrowed we dey borrow. Ehhh bros Amechi I beg fear god .Bros everything is wrong with it oooo.
Copyright (C) eagle hedge multimedia company limited.
For adverts placement call 08033207022
All this dem old papa dem wey dey steal, jail nor too late for dem o. E for good make dem try be tenants for prison make dem see how their thief thief don cause problem for we country...nothing dey work for this 9ja. Na big shame o
ReplyDeleteDis old set of politicians need brain reset
ReplyDeleteOnly God can help us
ReplyDelete