Labour Don Call Off Strike, New Electricity Tariff Don Pause For Two Weeks. BY: ORIH MICHAEL CHINAEMEREM Organised Labour, for early morning Monday 28th September 2020, don press pause ontop suspended Di strike wey dem wan do sake of say government increase prices of petrol and electricity. Dem agree to suspend Di strike inside communique wey labour leaders plus Di Federal Government representatives sign. Na Minister of Labour and Employment, Senator Chris Ngige read Di whole story give everybody, at di end of Di seven hours meeting. Di matter inside wetin dem sign bi say, “everybody don agree to set up Technical Committee wey Ministries, Departments, Agencies, NLC and TUC, go together work for two weeks, from Monday, September 28. “di job wey di committee get na to check why we need Di increment policy, meters, plus other many many tins. “people wey dey inside Di Technical Committee na: Mr Festus Keyamo(SAN), Minister of State Labour & Employment...