Labour Don Call Off Strike, New Electricity Tariff Don Pause For Two Weeks.

Labour Don Call Off Strike, New Electricity Tariff Don Pause For Two Weeks.

BY: ORIH MICHAEL CHINAEMEREM

Organised Labour, for early morning Monday 28th September 2020,  don press pause ontop suspended Di strike wey dem wan do sake of say government increase prices of petrol and electricity. 

Dem agree to suspend Di strike inside communique wey labour leaders plus Di Federal Government representatives sign.

Na Minister of Labour and Employment, Senator Chris Ngige read Di whole story give everybody, at di end of Di seven hours meeting. 

Di matter inside wetin dem sign bi say, “everybody don agree to set up Technical Committee wey Ministries, Departments, Agencies, NLC and TUC, go together work for two weeks, from Monday, September 28. 

“di job wey di committee get na to check why we need Di increment policy, meters, plus other many many tins.

“people wey dey inside Di Technical Committee na: Mr Festus Keyamo(SAN), Minister of State Labour & Employment, Chairman; Mr Godwin Jedy-Agba, Minister of State Power, member; Prof. James Momoh, Chairman, National Electricity Regulatory Commission, member. Engr. Ahmad Rufai Zakari, SA to Mr President on Infrastructure; member/Secretary, Dr OnohoOmhen Ebhohimhen, member (NLC); Comrade Joe Ajaero, member (NLC); Comrade Chris Okonkwo, member (TUC), and a representative of DISCOs, members


 If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471, 
(+234)09011708783
 
Whatsapp: 
(+234)09012543471, (+234)09011708783, 

Email: eaglehedge16@gmail.com

For your advert placement call:
(+234)09012543471, 
(+234)09011708783


EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY
All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, rewrite or distribute in full or in part, without di permission of 
EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY.

FOR YOUR ADVERT PLACEMENT CONTACT US

Copyright (C) 2020  Eagle Hedge Online News.

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.