Big Brother Naija na evil something, No watch am again – CAN

Big Brother Naija na evil something, No watch am again – CAN

By: PRINCESS EIGBOKHAN ORIH


Di Christian Association of Nigeria don carry megaphone dey tell all di political office holders plus to whom it may concern say make dem no allow bad bad tinz to dey happen again.
But  instead, make dem try dey run tinz wey go promote  justice, better sense plus make e be tinz wey go make baba God Almighty plus humanity dey Joli.

CAN provoke come knack hand for chest say make nobody watch Big Brother Naija, sake of say the programme na evil sumtin. CAN say make every Nigerians to join dem to dey say I no gree for di show.

Di Chairman of Christian Association of Nigeria CAN for Rivers State, Stanley Dimkpa made Yan say mall government people dem chuk mouth for dis matter sake of say make dem stop to dey show Big Brother NAIJA. 

CALL US ON 09012543471 TO PLACE YOUR ORDERS FOR YOUR QUALITY EXQUISITE SHOES. DELIVERY NATIONWIDE.


Dimkpa talk say big brother naija get some Kain kurukere immorality tinz plus lamba wey dey happen for inside. Na hin be why everybodi must not watch BBNAIJA. Him Yan say the immorality plus lamba wey dey inside d show fit to born som Kain evil pikin dem.


Dimkpa talk say As Christians make we dey do tinz wey go make brain at d same time make our obodo better.

Him Yan say make we create background wey be say no be only tribe, political party plus church go dey run tinz alone so we no go ask ourselves wetin we gain. but make we join body follow where equality, truth plus hard work be di koko according to Romans 12:9.
Because na di tinz we go fit take pursue  crimes, bad behaviour plus lamba wey dey follow scatter our obodo and wey make people do bad sumtin like  Big Brother Naija.

Stanley Dimkpa Yan say, him wan clear everybody say make everybody join mouth talk say "all we are saying no more Big Brother Naija"  because the show na evil somtin. 
But meanwhile Dimkpa talk say make we no dey encourage we family plus friends dem to dey watch Big Brother Naija, 


Copyright (c) EAGLEHEDGE MULTIMEDIA 2020

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.