EVERYBODY WEY I OFFEND ABEG NO VEX. I AM SORRY": AKEREDOLU


"EVERYBODY WEY I OFFEND ABEG NO VEX. I AM SORRY": AKEREDOLU

By PRINCESS EOGBOKHAN ORIH
  governorship primary for All Progress Congress, APC, Ondo State, don dey near, Governor Rotimi Akeredolu, don talk say him ready to beg to anybodi wey him for don offend since wey him become governor. Governor Akeredolu say make all of dem no vex sake of say make peace dey the ondo state.

Akeredolu Yan this one when him go see APC reconciliation committee wey Niger State Governor, Abubakar Bello be the chairman for Akure, ondo state capital.

Akeredolu Yan say: “We must to clear road so peace fit enter".  Him also Yan say make all aspirants dem, plus himself put hand for paper come free say anybody wey win, others must to support am.


Meanwhile Akeredolu still dey Yan say “Anybody wey him offend, make them sorry. Sake of say make peace for dey.”

EagleHedge Online News gather say The reconciliation committee, wey APC Caretaker/Extra Convention Planning Committee, dem setup dey Ondo state. Dem wan take opportunity meet every governorship aspirants,  leaders plus members of All Progressive Congress APC  Ondo state.

Akeredolu talk say APC na the very political party wey everybody for Ondo state carry for mind as their own but wetin remain na make the people begin enjoy plenty plenty things inside good governance.


Governor Akeredolu still talk say him administration don make sure say Ondo state people no get plenty worry again.

According to Akeredolu: “for this small time wey him don dey serve Ondo state people, say him administration don try well well because God na him make am possible for it to happen. So as e be so, him fit knack hand for chest say Baba God you too much.
Akeredolu Yan say him dey assure everyone say na APC get Ondo state and we go maintain am so. Except say some people get other other plans wey him call  shenanigans.
 
As
The Chairman for reconciliation committee, Abubakar Bello talk say the main thing the committee come do for Ondo state na to end all the gbege plus I no gree things wey dey happen inside the party. So that all party members go become brothers and sisters for the party and so that APC fit win well well for the next election.
But as the matter dey hot, chief Olusola Oke wey be aspirant don talk say the APC Reconciliation Committee just dey waste their time.


Chief Olusola Oke, bin no dey the reconciliation meeting but as governor Akeredolu comot for the meeting, him come show.
Chief Olusola Oke Yan say dem no let am know say such meeting dey happen before. But From wetin him hear from people wey come the meeting, e just mean say the meeting no get head. Say dem no yan anything new for the meeting as per the matter wey dey ground.

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.