Eyitayo Jegede Don Wins Ondo PDP Primary.


Eyitayo Jegede Wins Ondo PDP Primary

By Princess Eigbokhan Orih

23 July 2020



Di Tori don get shape as Eyitayo Jegede don win PDP governorship primary election  for Ondo State.
 

As dem say "on your mark get ready go", na so Eyitayo Jegede take run pass all di other aspirants dem come carry first position.
So as the Tori dey hot, EYITAYO JEGEDE be di authentic  Peoples Democratic Party  (PDP)’s governorship candidate for the Ondo State governorship election wey go happen on October 10 2020.

Na for Wednesday 22nd July 2020 we hear  say Jegede win Di primary election.
Dis one happen after all di  delegates dem don cast votes for the PDP party primary wey happen for inside International Culture and Events Center, (dome) for Akure, ondo state.

EagleHedge Online news hear say EYITAYO JEGEDE take 888 votes take win di Deputy Governor of ondo state, Agboola Ajayi; wey get 657 votes plus all di other seven aspirants wey waka come Di race.

other aspirants wey waka come for di PDP governorship primary election for ondo state plus there scores na:
 Eddy Olafeso wey collect 175 votes 
Banji Okunomo wey collect 90 votes 
Olabode Ayorinde  95 votes
 Boluwaji Kunlere 33 votes
 Olusola Ebiseeni 29 votes
 Godday Erewa 14 votes.
All di votes wey no make sense wey dem throwaway na 64.
CALL PRESIDENT MALL ON 09012543471 TO PLACE YOUR ORDERS FOR YOUR EXQUISITE AND QUALITY SHOES. DELIVERY NATIONWIDE.



meanwhile my people make we clear Una say na indirect system PDP ondo state use for di primaries.
So as Di Tori dey go, when di Chairman for di PDP Primary Election Committee wey bi Di Governor of Enugu State, Ifeanyi Ugwuanyi see say true true, with our koro koro eyes, Di difference is clear; 
Na so him clear everybodi say Jegede na di man wey win.

Other people wey come torch light as Di primaries dey go na Adamawa State Governor, Ahmadu Fintiri plus other strong politicians.

Well anyway is a way, dis one no bi shoot bird him mama fly. As Di matter bi so, EYITAYO Jegede na him go face Governor, Oluwarotimi Akeredolu wey bi Di All Progressive Congress APC governorship candidate for di governorship election wey go happen very very soon.



 
Copyright © 2020 EAGLEHEDGE MULTIMEDIA COMPANY LIMITED. All rights

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.