Ghanaian Traders Say make Nigerian traders no sell For Ghana again.


Ghanaian Traders Say make Nigerian traders no sell For Ghana again.

BY ORIH MICHAEL CHINAEMEREM

Okokobioko! Chai no bi small kasala dey burst for Ghana. Na as we hear Di Tori, na so we go bring am give Una.

No bi small gbege dey happen for inside Abossey Okai spare parts market for Accra, Ghana.
Na so all Ghana market people dem lock-up all di shops of Nigerian traders.
CALL PRESIDENT MALL ON 09012543471 FOR YOUR EXQUISITE AND QUALITY SHOES. DELIVERY NATIONWIDE WITHIN 48HRS.

Una know say The Ghanaian traders dem don provoke infact dem talk say for inside Ghana, Di law no gree any foreigner make him dey sell for retail.


Di Ghana traders talk say Di  Nigerian traders dey sell substandard products. 
E no finish for there. Di Ghana traders talk say Nigerian traders dey sell Di substandard goods for low prices and dis Kain tin dey kill their business.

Di local market people for Ghana dey para. Dey even claim say  Nigerians get plenty money and dem dey use di money take intimidate dem. 
Dem talk say Nigerians go just use money dey show dem self anyhow sake of say dem fit to pay Di big big price wey shop owners dey put shop rent. 
Na all dis tins make Ghana traders lock shops of Nigerians plus make dem no dey do “illegal” operations.

Meanwhile Di  Nigerian traders no loose guard. Na so dey dem self dey para sake of say Di way wey Ghana traders dey open eye for dem.

Di chairman for Nigerian Traders Association of Ghana chief emeka nnaji  don tell him members say make dem no dull dem selfs. Infact make dem ready give di Ghana traders gbege rush rush like rapid response unit.

Chief Emeka Nnaji, talk say e dey pain am sake of say Ghana government plus police just Sidon dey look. Inshort dem no do anything take help Di Nigerian traders at all at all.

Chief Emeka still talk say if  Ghana traders want make dem leave ghana, say dat one no be problem but make Ghana traders just come buy all di goods wey dem get for inside their shop.

Meanwhile as Di matter dey hot, di MP for dat area, Ebenezer Gilbert Nii Narh, Di market union for Abossey Okai plus police commander for di area don go do two aside, so dem fit to see how dem go settle Di matter.
When dem finish Di meeting, dem go tell us wetin bi Di way forward.


Copyright (c) 2020 EAGLEHEDGE MULTIMEDIA COMPANY LIMITED

For advert placement please call 09012543471
08033207022
Or email us on eaglehedge16@gmail.com

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.