HOUSE OF REPRESENTATIVES DON DEMAND NAMES OF MEMBERS WEY AKPABIO SAY DEY COLLECT NDDC CONTRACT.

HOUSE OF REPRESENTATIVES  DON DEMAND NAMES OF MEMBERS WEY AKPABIO  SAY DEY COLLECT NDDC CONTRACT.

BY PRINCESS EIGBOKHAN ORIH.

The House of Representatives don give the Minister of Niger Delta Affairs, oga Godswill Akpabio, 48-hour ultimatum to publish all di names of all members of the 9th National Assembly wey him say collect  60 percent of di contracts wey come out from the Niger Delta Development Commission (NDDC) say na dem collect tam.


FOR YOUR QUALITY SHOES CALL US 09012543471 TO PLACE YOUR ORDERS. DELIVERY NATIONWIDE.


Di oga Speaker for the House of Representatives, Femi Gbajabiamila, don give  this go ahead the time wey him dey ruling on top of di matter of privileges moved by the minority leader, Ndudi Elumelu, during village meeting (plenary) on Tuesday.


Gbajabiamila say make the minister no only publish di names of the lawmakers wey chop from NDDC contracts, but also all the companies and the contracts wey dem don do.


everybody for nijia don dey Wait to hear wetin go happen after 48 hours. The question be say oga Akpabio go gree talk or abi this matter go still be like tori for gods.

Comments

  1. Hahahaha haha! Fire go dey burn for dat Akpabio for hin yansh. E get less than 24hrs to produce the Ghost wey follow am chop d moni...

    ReplyDelete
  2. Him no fit just cook the tori nau. Abi?

    ReplyDelete

Post a Comment

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.