Nigerian man write letter give 'Abuja witches and wizards.

Nigerian man write letter give 'Abuja witches and wizards.

BY ORIH MICHAEL CHINAEMEREM
23 JULY 2029



My country, my country. For dis obodo Nigeria, wonder no go ever end. 


Wetin EagleHedge Online news no go use ear hear. But as we hear am, na so we go Yan Una.
Una fit imagine, one guy man wey him Facebook name na ''Last Battalion'' done provoke come carry gbege go meet witches plus wizards dem for Abuja.

 Dis guy man use all alacrity take write letter give Association Of Witches and Wizards Nigeria, Kubwa-Abuja chapter.
For di letter, Last Battalion talk say him dey warn Di witches plus wizards dem make dem stop to dey lllsend their ''recruits plus apprentice'' dem come him room again.

Last Battalion put him letter on top social media after him don popo one cat wey come near him domot.

As him kpai Di cat na so him post Di cat wey him kill ontop social media come write:
LETTER TO WITCHCRAFT ASSOCIATION OF NIGERIA KUBWA- ABUJA CHAPTER

ABEG make Una no dey send recruits or apprentice come my room next time...

Him say all kurukere plus nkoro wey dem send come him side go die for inside 24hrs!

(Him stand gidigba)
CALL PRESIDENT MALL ON 09012543471 AND PLACE YOUR ORDERS FOR YOUR EXQUISITE AND QUALITY SHOES. DELIVERY NATIONWIDE.



Copyright (c) 2020 EAGLEHEDGE MULTIMEDIA COMPANY LIMITED
 

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.