POLICE DON ARREST 35 SUSPECTS FOR KIDNAPPING PLUS OTHER CRIMES.

POLICE DON ARREST 35 SUSPECTS FOR KIDNAPPING PLUS OTHER CRIMES.

BY ORIH MICHAEL CHINAEMEREM

Police Intelligence Response Team (IRT) don arrest thirty-five (35) suspects.
Dem catch all di  suspects for different area for obodo Nigeria.
 Dem gbab dis suspects dem because dem put hand for plenty plenty bad bad tins wey be kidnapping, armed robbery.Una remember say Nigerian police don knack hand for chest come talk say pikin wey say him mama no go sleep, him self no fit to sleep. Police don agree say dem no go rest until they pursue people wey dey commit crime for obodo Nigeria.
 
Among Di suspected criminals wey dem arrest na one 52 year old pastor wey bi Di Founder and General Overseer of New Life Ministry, Lukosi, in Shagamu Area of Ogun State pastor Adetokumbo Adenopo plus him gang members wey bi Chigozie Williams, Ugoji Linus plus Emmanuel Chris Ani.
Dis pastor plus him gang members kidnap Mr Jonathan Ekpo.
pastor tell Nigeria Police operatives say him enter kidnapping sake of say him wan expand him church plus say him dey use di money dey do charity work.
Pastor talk say dem kidnap Di victim on 17th of July, 2020 for when him dey go deliver goods for Shagamu, Ogun State.
The police talk say na for one underground inside the Pastor’s church for Ogijo town, Ogun State dem put  Mr Jonathan Ekpo come tell him people say make dem bring twenty million naira before dem go release am.
However, police don rescue Mr Jonathan Ekpo nine days after and dem don reunited ham with him family.
EXQUISITE AND QUALITY SHOES FOR SALE AT PRESIDENT MALL. CALL 09012543471 TO MAKE YOUR ORDERS


Meanwhile, As Di tori dey go, Police still arrest Udodiri Bright aka Ability, Ekwuru Shadrack aka Escobar, Chimerie Igwe aka 4real plus Chibuike Sunday.
Police arrest dem on 5th of July, 2020 because say dem kidnap come kill one Nigerian wey bi Soldier for America, wey him name bi Chuks Okebata.

Di suspects dem bi ogbonge men for inside kidnapping and na dem dey worry for South Eastern part of Nigeria.

 Police also arrest another 9-man gang wey their job bi armed robbery plus to dey thief car for border.
 Police talk say Yakubu Hayatu, bi gang leader. Other members bi Adamu Awalu, Abdulrahman Yakubu, Yususf Adamu, Kamal Japhet, Abubakar Samaila, Muhammadu Abdulahi, Yahaya Mohammed, plus Ibrahim Abubakar.
When police torch light Di matter, na so dem findout say dis gang don thief over thirty exotic cars at gun point and dem don killed two Policemen as dem dey operate. 

Police talk say dis gang dey use anti-tracker device take dey dodge police. Meanwhile as dem thief motto finish, na one Alhaji Garba for Maradi, Niger Republic dem dey go give Di motto wey dem thief.

For dis operation Nigeria Police team don collect Eighteen vehicles back but dem dey work with INTERPOL so dem fit catch Alhaji Garba come recover Di remaining vehicles.

Wetin Police collect from Di suspects dem bi 4 Ak47 Rifles, 1 FMC rifle, 1 Pump Action Gun, 2 double barrel guns, 1 Beretta pistol, 4 AK47 Magazine, 6 cartridges, 378 Rounds of live Ammunition, 1 Network Jammer (anti-tracker device).

MeanWhile police talk say all di suspects go reach court when dem finish to dey torch light Di matter.

As Di matter bi so, di Inspector-General of Police, IGP M.A Adamu, NPM, mni don tell everybody say make dem relax because police no go rest until dem catch all criminal elements wey dey obodo Nigeria.

Copyright (c) 2020 EAGLEHEDGE MULTIMEDIA COMPANY LIMITED

FOR ADVERT PLACEMENT PLEASE CALL 08033207022
09012543471

Comments

Post a Comment

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.