THE LIVING FAITH DECONESS WEY USE HOT KNIFE PLUS LIGHTER BURN 14 YEAR OLD GIRL DEY JAIL

Stori don full ground berekete. Una remember hanty Yemi Awolola, wey be deaconess for Living Faith Church wey dem dey call Winners' Chapel.


Dis deconess wey carry hot knife and gas lighter take scatter scatter the genital area,of one 14 year old pikin wey dem put for her hand. 


Deconess Yemi awolola don tell court say she dey guilty for everything wey dem say she do.



As the matter dey hot, EagleHedge Online don findout say Deconess Awolola even use stick take chuku chuku the small girl vagina.


Make Una no forget say this Deconess Awolola, be staff for Nigeria National Petroleum Corporation, NNPC.

Deconess Yemi Awolola on Monday because of this matter wey dey ground so reach Magistrate Court 3, for Kaduna,


Even as Deconess Yemi Awolola agree say she guilty and say she commit the crime, Justice Bashir Yusuf Shittu, wey be the presiding magistrate, talk say him no fit  to convict Deconess Awolola sake of say the matter take style pass him level but him go still chuk mouth for the matter wey dey ground


No be only hanty Yemi Awolola waka com for this matter because her two pikin dem follow for this kasala.

Anyway, Justice Shittu don grant bail give hanty Awolola two pikin but na N700,000 dem go pay before them go fit march out but justice shittu no give hanty Yemi Awolola bail.


EagleHedge Online hear say One of hanty Yemi Awolola pikin wey be boy, wey follow  injure this small 14year old girl wey her name na Princess don take off. EagleHedge Online hear say as the boy hear say the matter don turn strong thing, na so him migrate go Lagos make our gallant police no arrest am join.


Anyhow, as the matter be so, the judge for this case don clear everybody say this case na to be continued for August 27 but meanwhile make hanty Deconess Awolola go relax for Kaduna Correctional Center.


Make Una no forget say we been hear say  this woman and her children show one small girl wey dey live for her house, wey  her name be Princess, strong thing.


Make Una no forget say we hear say this woman hanty Deconess Yemi Awolola been promise the girl family say she go send her go school.


The small girl family don beg we obodo Nigeria people make we help them sake of say dem show their daughter strong thing.


As we dey Yan so, the small girl dey for hospital for Kaduna.

Comments

  1. Chaiii!! Abeg make plenty hands touch am for that jail. Egbe!!!

    ReplyDelete
  2. See wickedness. She belongs in jail

    ReplyDelete

Post a Comment

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.