Skip to main content

The oga before before for NDDC, Joy Nunieh and the oga minister Godswill Akpabio don fight for market square


Plenty gbasgbos don dey happen between di former NDDC oga-madam Joy Nunieh, and di minister of Niger Delta Affairs, Senator Godswill Akpabio as di  two oga and madan shook leg inside one trouser.


Country people never hear word since wen this two people start their fight unto thief thief matter wey don  shele for inside NDDC.

As di gbasgbos between di two dey blow dey go. 

Oga President Muhammadu Buhari on the On February 19 2020, comot  madam Nunieh as acting Managing Director of di Niger Delta Development Commission (NCDC) come put Kemebradikumo Daniel Pondei to take ova.


Oga Presido also order di audit of NDDC 2019 account unto say goment don pump billions of naira for di agency but notin to show for am.


Di case com get k leg as the kwanta between di oga madam Joy and Akpabio com  catch fire on Saturday 11 July, afta madam Nunieh drop bomb give tori pipo say na di Niger Delta minister wey dey supervise her agency remove her from office becos she no gree play ball.


Some of di accuse wey she sama against di minister be say im bin try force her to swear oath of secrecy so dat she no go fit expose fraud wey dey happun for di agency.(juju)


According to madam Joy "  im tell me to raise memo to use mago-mago take give contract to flood victims for Niger delta," 

She also yan say  "nobody fit do any payment for NDDC witout oga Akpabio approval." She say She get evidence of dis accusations wey she dey yan so.


As the matter dey hot na so oga Godswill Obot Akpabio tell  tori pipo say make dem go interview aunty Joy four husbands on top her character.AS Akpabio say di former NDDC boss-lady no get character. He also yan say make aunty Joy go hospital go see doctor plus collect injection.


Im come add say, "I no tok say anytin dey worry her, but I dey say sometin dey worry her temper. Remember say she don marry about four husbands."

Di minister say dem sack her sake of  say she no get respect  and sake of say she no gree ansa di many query wey di ministry wey dey in charge of supervising di agency bin give her plus say anti-corruption group bin write petition against her.

Im add say on top of dat one, di kontri National youth service Corp say her name no dey dia record say she do NYSC, dat na why dem remove her."


As oga Akpabio take hin time take tell tori people all the gbege wey make aunty Joy collect sack letter from NDDC. Na so  Madam Joy, sama more accuse on top di minister head for interview wey she do wit Arise TV.


She say oga Akpabio bin try to do budget padding to increase di moni during her tenure. She also yan say Im even order her to add some of di projects wey di refugee commission dey do inside NDDC budget, she tok.

"Akpabio bin write me to put list of projects from di refugee commission inside di NDDC budget."

On top all dis one she add say, she slap di minister for face becos im sexually harass her. She also yan say Akpabio go hear from her lawyer on top of the four husbands wey hin talk say she get because she  no get any four husbands na because of this na hin make Akpabio to invite her to hin Lodge where hin be wan join with her.

Joy hala say she bi port Harcourt girl. She also say Akpabio girl friend go meet the clerk of the Senate say make hin add some pepper to the budget wey she oga madam Joy don sumitte give Senate, she say because she refuse to allow the lady play with her carrier as the oga MD Akpabio vex for her as he wan her say she dey play with her job.


Early dis month, di commission bin face di Senate Ad hoc committee wey dey touch light for matter to explain why di acting Managing Director of di Niger Delta Development Commission (NCDC) come appoint Kemebradikumo Daniel Ponde share N1.5 billion allowance for Covid-19 among dia management and staff.

As Nigeria people dey shout up and down for social media say we never see this kind corruption before because the corruption wey Di investigative public hearing wey still dey happun dey shook eye inside di different mago-mago wey dey happun for di agency use style style wear face cup, wear T.shirt plus Jean trouser and designer shoes.


As the matter dey go, the question wey dey Nigeria people lips be say if one man spent 8years for office as governor and 4 years as senator and just few months as minister for NDDC 81 billion don enter hole without any project then you go com sit down calculate how much for don enter hole for 12 years.

#lootingnigeriafutureaway.

Copyright (c) Eagle Hedge Online News

Comments

  1. Na wa o!! Na who come be the thief for this two matter now ehn? All of dem jst dey thief thief yanfj yanfu!

    ReplyDelete

Post a Comment

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.