Yakubu Dogara, don come All Progressives Congress (APC) again.

Yakubu Dogara, don come All Progressives Congress (APC) again.

BY ORIH MICHAEL CHINAEMEREM
24 JULY 2020

Una don hear say Di oga before before for House of representatives wey dem dey call "SPEAKER" Yakubu Dogara don come back to APC?
Di Governor of Yobe state wey also bi Di acting Chairman of APC, Mai Mala Buni, tell EagleHedge Online news for Friday.
Oga mai mala buni yan dis one after him plus oga Dogara go meet oga President Muhammadu Buhari for presidential villa.

Oga Buni yan say president BUHARI  welcome oga Dogara well well.

Meanwhile oga Buni don talk say why oga Dogara leave APC before no bi wetin we suppose to dey talk again but as Dogara don show so, come go see oga President Buhari, na make dem for join body come carry APC go higher level.
CALL PRESIDENT MALL ON 09012543471 FOR YOUR EXQUISITE AND QUALITY SHOES. DELIVERY NATIONWIDE. 

Di oga before before for House of representatives Yakubu Dogara don clear everybody say make dem no worry but very soon, him go Yan everybodi as Di matter bi.

As Di Tori bi so make I remind Una say na for Inside January 2019, Yakubu Dogara tell everybody say him dey comot from APC come go join Peoples Democratic Party (PDP).
Make Una no worry, as Di Tori dey move go permanent site, we go dey give Una hot hot.

 



Copyright © 2020 EagleHedge MULTIMEDIA COMPANY LIMITED. All rights reserved.

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.