Zamfara Lawmaker don share Detergent, Cloth Pegs Plus Local Pressing Iron As Empowerment.

Zamfara Lawmaker don share Detergent, Cloth Pegs Plus Local Pressing Iron As Empowerment.

BY ORIH MICHAEL CHINAEMEREM


My people our Tori blow us reach zamfara where Hon. Kabiru Mai-Palace wey dey rep Gusau/Tsafe for zamfara state, don give 120 women for Tsafe Local Government Area of Zamfara multi-million naira empowerment.

Na for inside Tsafe town him launch Di empowerment.
For dis level, Di people collect plenty plenty things wey bi like Refrigerators, Grinding and Sewing Machines, Clothes Pegs, Local pressing irons, detergents, fetching bowls plus other items, wey dem fit dey use hustle .

Hon. Mai-Palace talk say dis thing wey him do so, na to help support wetin zamfara state government dey do so people go get work, plus make hunger no kill people sake of say dem no get money especially women.

Meanwhile Di PDP Chairman for zamfara state, Alhaji Ibrahim Mallaha, thank di lawmaker well well for di correct sense plus mind wey him get take do di empowerment for the people. Infact him talk say wetin Di lawmaker do so, dey parley with wetin dey inside PDP manifesto.

PDP Chairman for zamfara state, Alhaji Ibrahim Mallaha come dey tell other party members say make dem try copy wetin Di lawmaker do so. Dis na because, dis Kain thing go help support wetin zamfara government dey do ontop empowerment.
CALL PRESIDENT MALL ON 09012543471 TO PLACE YOUR ORDERS FOR YOUR EXQUISITE AND QUALITY SHOES. DELIVERY NATIONWIDE WITHIN 24HRS




Copyright © 2020 EagleHedge Multimedia Company Limited.

FOR ADVERT PLACEMENT PLEASE CALL:
+234-08033207022 +234-09012543471
eaglehedge16@gmail.com

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.