Benue Lawmaker dey Prison because of Criminal Conspiracy, Kidnapping



Benue Lawmaker dey Prison because of Criminal Conspiracy, Kidnapping

BY: ORIH MICHAEL CHINAEMEREM. 

Dem don carry di lawmaker wey dey represent Katsina Ala East state constituency for inside Benue State House of Assembly, Honourable Jonathan Agbidye go prison custody because say e bi like him put hand for criminal conspiracy, armed robbery plus kidnapping on August 21, 2020.
 
Dis one happen for Chief Magistrate Court for markurdi.
 na Mr Isaac Ajim bi Di judge for dis case and Mr Issac talk on Friday say make dem keep Di lawmaker wey dey represent Katsina-Ala East state constituency in the Benue State House of Assembly, Honourable Jonathan Agbidye for prison custody for alleged criminal conspiracy, armed robbery plus kidnapping.

Hon. Agbidye plus one Denen Zuamo wey come from Katsina-Ala town na di two both of dem dey police custody because of di alleged offence.

police prosecutor, wey him name be Fidelis Ogbobe been tell di court say on May 22, 2018, dem snatch one Toyota Hilux van wey di registration number bi SWA-215-FM plus other plenty plenty michi michi things wey Apin Public Health Initiatives be di owner ontop gunpoint along Katsina-Ala -Tordonga road for Katsina-Ala Local Government Area. Dem come carry all di things go unknown destination.

Fidelis talk say when police begin to dey torch light Di matter, na dat time dem gbab Di lawmaker plus him partner for where dem dey with Di vehicle. But meanwhile di vehicle don get another registration number wey bi MKD-992-AD.

Fidelis talk say as police continue to dey torchlight Di matter, na him dem find out say Hon. Agbidye, Zuamo plus other men wey dem still dey find, belong inside gang of armed robbers and terrorists wey one notorious kingpin, wey him name bi Terwase Akwaza alias ‘Ghana’ bi Der oga.
Police talk say na dis people snatch, rob, come abduct staff of Apin Public Health Initiatives.
Fidelis still talk say all di accuse people break law according to Section 1(2) A and B and section 6(b) of di Robbery and Fire Arms (Special Provisions) Act, 2004, and Hostage, Kidnapping, Secret Cult plus Similar Activities Law of Benue State, 2017.

Di police prosecuting counsel  tell court say Di matter na to bi continued because dem still dey torchlight more for Di matter. Na him bi why dem ask court make him give dem another date sake of say make dem fit to finish work ontop di torchlight things.
Meanwhile Di lawyer for all di accuse people, Barrister Terhemen Oscar Aorabe no talk put for Di matter but him tell court say him go formally apply for the bail for him client on another date.

Dis matter go continue for on di October 12, 2020.

As Di matter bi so, Hon. Agbidye plus Mr Zuamo go dey Federal Correctional Facility for Makurdi.
If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471, 
(+234)09011708783
 
Whatsapp: 
(+234)09012543471, (+234)09011708783, 

Email: eaglehedge16@gmail.com

For your advert placement call:
(+234)09012543471, 
(+234)09011708783


EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY
All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, rewrite or distribute in full or in part, without di permission of 
EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY.

FOR YOUR ADVERT PLACEMENT CONTACT US

Copyright (C) 2020  Eagle Hedge Online News.

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.