Governor appoints special assistant on unmarried women affairs


Governor appoints special assistant on unmarried women affairs


By ORIH MICHAEL CHINAEMEREM

Bauchi State Governor, Bala Mohammed, don appoint Balaraba Ibrahim make she be him Special Assistant on unmarried Women Affairs .

Di Bauchi governor talk dis one ontop letter wey dem write on Di 4th August 2020 and na di Secretary to di State Government, Mohammed Baba sign am.


For inside Di letter, Di Bauchi state governor talk say “ him wan clear everybodi say him don approve plus appoint Balaraba Ibrahim make she bi Special Assistant, Women Affairs (Unmarried).

“him say Di appointment na onto say  Balaraba Ibrahim get plenty sense, experience plus personal qualities wey bi hard work, honesty plus loyalty. 

Di governor talk for Di letter say, as e bi so, him go like make she use all dis qualities take put eye for work wey she collect sake of say make Di work for dey go well well.

Na Balaraba Ibrahim bi oga, for Association of Divorcees inside Bauchi State.

Just Last year here, she arrange counselling for people wey dey plan make dem marry.

Balaraba Ibrahim, talk say she shock because of Di way wey small small girls wey don marry dey comot from inside Di marriage dey plenty.

She Yan say dis matter na serious matter wey fit to cause gbege later later. 
Balaraba Ibrahim talk say as dem torchlight dis matter for 20 local government inside Bauchi state, dem findout say unemployment, poverty plus early marriage follow for Di tinz wey dey cause make dis girls dem say dem no marry again.
MeanWhile  Balaraba Ibrahim say some of Di girls tell her say their husbands no dey capable enof. 

Inshort man wey no fit to behave like husband, provide money for correct food, better cloth plus beta house for him family, dat one na man?.

Balaraba Ibrahim talk say Some of Di girls wey be 20years old, don marry, since wey dem bi 15years old and even some don even leave their marriage since 10 years ago.
As Di matter bi, Balaraba Ibrahim findout say some men dey even run from marriage, while Di ones wey get mind to marry, no dey capable.

So as e bi so, she done conclude say Di way forward na to partner with imams, Alfa, pastors plus other religious people dem, so dem fit join together to dey talk to all dis people wey wan marry. So that dis people mind go dey activated ontop wetin dey go see inside marriage. 


If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471, 
(+234)09011708783
 
Whatsapp: 
(+234)09012543471, (+234)09011708783, 

Email: eaglehedge16@gmail.com

For your advert placement call:
(+234)09012543471, 
(+234)09011708783

Copyright (c) 2020 EAGLEHEDGE MULTIMEDIA COMPANY LIMITED.

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.