Governor go introduce death sentence for drivers.



 Governor go introduce death sentence for drivers.

By: ORIH MICHAEL CHINAEMEREM

Di Governor for zamfara state, Governor Bello Mohammed Matawalle don talk say him no go waste time to bring death sentence ontop reckless drivers for zamfara state.

Di governor talk dis one wen him and him state executive council plus management of BUA Group go tell Emir of Gusau, Alhaji Ibrahim Bello sorry because of Di accident wey happen 15 people been die.

Zamfara state Governor talk say as e bi am so, him no go waste time to bring death sentence enter Di state sake of say drivers wey dey drive anyhow don dey boku.
Him say Di death sentence law go make drivers to pay money give anybody wey dem kill for road.


Governor Matawalle say e pain onto say 15 persons just die just like dat because of anyhow driving of one truck driver wey kill did people for Wednesday wey don pass for Gusau/Funtua road.

Di Governor also talk say him go give N2 million each to Di families of Di people wey die and wey get wife and  N1.5 million to families of Di ones wey never marry.

The governor still talk say all di next of kins of Di people wey die, him go dey give dem monthly allowance of N50,000 each until him comot as governor.
As Di matter pain Di Governor reach, him say him government go introduce speed limit gauge ontop highway plus  weight measurement ontop trucks plus drug tests for drivers because dem go need to stop drivers wey dey drive anyhow.
Di Governor come tell management of BUA company to warn dem drivers make dem no run speed anyhow again because Di 15 people wey die na big loss. Him come pray make Allah accept Di souls of Di ones wey don die for Jannatul Firdaus.
 If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471, 
(+234)09011708783
 
Whatsapp: 
(+234)09012543471, (+234)09011708783, 

Email: eaglehedge16@gmail.com

For your advert placement call:
(+234)09012543471, 
(+234)09011708783


EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY
All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, rewrite or distribute in full or in part, without di permission of 
EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY.

FOR YOUR ADVERT PLACEMENT CONTACT US

Copyright (C) 2020  Eagle Hedge Online News.


Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.