Governor Obaseki Order Edo state house of Assembly Roofs removed


Govnor Godwin Obaseki don accuse police, Adams Oshiomhole, Hope Uzodinma of plans to 'take over hin government'.

By Princess Eigbokhan Orih.

Govnor Godwin Obaseki order di removal of  di roof of Edo State House of Assembly make nobodi do sitting again  afta di govnor kwanta wit police people wey attempt to take over di house of Assembly Complex.

All dis gbege happen after president Buhari endorse Osagie Ize-Iyamu for Edo election wey dey happen next month.
Before govnor Obaseki order di contractors to turn di Assembly complex to renovation project site, e bin don pursue police officers wey bin take over di building of di Edo State House of Assembly wey dey di state capital, Benin City.
Di Special Adviser to di Govnor ontop Media and Communication Strategy matter, Crusoe Osagie wey bin follow Eagle Hegde News tok on behalf of di Govnor, accuse Oshiomhole heavy accuse say na im dey behind di attempt to take over government from Obasrki.

Oga Oshiomhole tok tok pesin Simon Egbegbulem tell country people say all wetin Govnor Obaseki dey tok no be true. Say na big lie e say "Oshiomhole no get hand inside wetin dey happun for Edo State House of Assembly."

Accordig to Oshomole tok tok persin Osho babs no get bizness, e no be lawmaker, e no dey inside di assembly, e dey far away from im village inside Iyamor wia im dey campaign for im party for di coming election and e no get bizness wit wetin dey happun in di assembly."
Egbegbulem narrate say"Wetin dey really happun for di assembly, (I tink di govnor just dey lie) na say... you know say we get 24 member house of assembly, and 20 of dem na APC members, then you get four PDP members and as you dey aware, di govnor don waka go PDP.  

"So because di APC na di majority for di house, na dem suppose produce di Speaker, Deputy and oda senior positions for di house because na dem be majority, but di govnor dey stop dem from entering di assembly."
Egbegbulem say Gov. Obaseki take police and thugs, wey take over di place right now, and e dey pull down di roof of di assembly house to stop dis pipo (di 20 APC lawmakers) from operating and cari out dia lawful duty, Oshiomole tok tok pesin add put.
And Govnor Hope Uzodinma of Imo State for e own  respond to di accusation as at di time of dis tori na so hin say him dey disappointed at wetin Gov Obaseki dey yan. Gov Uzodinma tok tok pesin Oguwike Nwachuku say him own put.

Tori be say di govnor and di speaker of Edo State House of Assembly on Thursday prevent wetin for mean by force take over of di assembly complex.

Na early morning na hin some  group of police men and some members of di House of Assembly wey dem never still swear in, waka go visit di Chief Anthony Enahoro Complex, na dia crowd of supporters gather block di city centre.
Shortly afta di govnor leave di assembly complex, construction trucks drive into di assembly gate begin deliver stones and sands for di main gate.

Di speaker wey bin escort di govnor also give instruction of no entry into di Assembly complex.


Trucks don move in sands and stones to di assembly entrance while di speaker and di deputy govnor sit done dey supervise the workers.


Dis incident dey come shortly afta di state members of Assembly bin impeach di Deputy Speaker of di House, Yekini Idiaye. Dem bin replace Idiaye wit Roland Asoro, one lawmaker wey dey represent Orhionmwon II Constituency.


Edo State House of Assembly roof na im di pipo wey di govnor bring dey remove on Thursday morning so dat no sitting fit hold. But di Govnor office tell country people say di work men go to renovate di Assembly complex. And say di lawmarkers don move go di old Assembly complex.
Even though Gov. Obaseki don waka from APC join PDP, Edo State matter to APC
Politics na game of numbers and every state dey important to any political party.

For Nigeria ruling All Progressive Congress party, di more states wey dem get to govern, di more power wey dem go fit enjoy on top different states.
Until Edo state governor Godwin Obaseki bin resign from APC on June 16, 2020, di party bin dey control 21 states while opposition Peoples Democratic Party bin dey im charge of 15 states.

As govnor Obaseki register as PDP member on Friday 19 June, e mean say di party now get 16 states, at least till di 19 September election happun.

On top of dat, Edo na di only state wey APC bin fit get for South-South Nigeria afta di 2019 governorship election for Nigeria.

 If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471, 
(+234)09011708783
 
Whatsapp: 
(+234)09012543471, (+234)09011708783, 

Email: eaglehedge16@gmail.com

For your advert placement call:
(+234)09012543471, 
(+234)09011708783


EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY
All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, written or distributed in full or in part, without di permission of 
EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY.

PRINCESS EIGBOKHAN ORIH
View all posts by Princess Eigbokhan Orih.

NEXT ARTICLE
Home
NEWS SPORTS ENTERTAINMENT VIDEOS RELATIONSHIPS POLITICS FORUM CONTACT US ADVERTISE WITH US PRIVACY POLICY
Copyright (C) 2020  Eagle Hedge Online News


Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.