Ibadan Suspected Serial Killer don take off for inside Police Custody

Ibadan Suspected Serial Killer don take off for inside Police Custody


BY ORIH MICHAEL CHINAEMEREM

E don happen ooooo! Everybodi come hear oooo!

Oyo State Police Command Don tell everybodi say one bros wey him name bi Sunday Shodipe, wey police dey suspect say him job na to dey kill kill people anyhow,  don escape.
Police talk say dis bros way no pure. As per say e get as him waka take join body with some ritual kill kill of people for Akinyele area for Ibadan, Oyo State.


Joe Nwachukwu Enwonwu, wey bi di Commissioner of Police for Oyo state, Yan dis one with Di mouth of him talk talk person wey him name bi Olugbenga Fadeyi.

Di Commissioner of Police, Oyo State Command, CP. Joe Nwachukwu Enwonwu, talk say, him wan tell everybodi say day bros wey dem torchlight as prime suspect for Di kill kill for Akinyele Local Government Area, Moniya Ibadan, wey him name bi Sunday Shodipe.
The commissioner talk say Sunday Shodipe wey dem arrest plus two other people on 17th July, 2020 don escape from police custody  on 11/08/2020.
Di Commissioner of police talk say him wan talk sikini chance take tell everybodi say make dem shine dem eyes.
Him talk say if anybodi see Sunday Shodipe, make dem hold am down, use rope tie am. Come sharperly control Nigeria police. "

 If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471, 
(+234)09011708783
 
Whatsapp: 
(+234)09012543471, (+234)09011708783, 

Email: eaglehedge16@gmail.com

For your advert placement call:
(+234)09012543471, 
(+234)09011708783


EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY
All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, rewrite or distribute in full or in part, without di permission of 
EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY.

FOR YOUR ADVERT PLACEMENT CONTACT US

Copyright (C) 2020  Eagle Hedge Online News.

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.