Ireland wan deport €5.5m Abacha money to Nigeria

Ireland wan deport €5.5m Abacha money to Nigeria.

By ORIH MICHAEL CHINAEMEREM


Ireland government don agree plus sign MoU with Nigeria say dem wan repatriate €5.5 million. money wey abacha use control number plus mago mago carry comot from obodo Nigeria.
Na di Department of Justice and Equality talk dis one on Thursday 13th August 2020.

Una see dis money, na part of  di $5billion  wey  General Sani Abacha, thief for 1993 and 1998.
Madam Helen McEntee, wey bi Di Minister for Justice and Equality, talk say she dey happy as she , sign Di MoU with Nigeria because dis one mean say after all di torchlight wey Criminal Assets Bureau follow join body do. 

Wey open dem eye come see $1bn wey bi equal to €5.5 million inside one bank account for Dublin and wey also bi part of Di money wey General Sani Abacha theif.
 MeanWhile for October 2014, Nigerian government send letter give Ireland government say make dem try send us Di money. 

Na him bi why for 2019 High Court for Ireland command make dem begin how dem go send dis ogbonge money give Nigeria.

According to Madam Helen McEntee, Di money wey Ireland wan return so, na di first time wey Ireland go do such things plus e go show say Ireland don carry leg, stand gidigba to cooperate with anybody wey ready to fight against corruption and to help countries wey dey suffer from corruption before.


If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471, 
(+234)09011708783
 
Whatsapp: 
(+234)09012543471, (+234)09011708783, 

Email: eaglehedge16@gmail.com

For your advert placement call:
(+234)09012543471, 
(+234)09011708783


EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY
All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, rewrite or distribute in full or in part, without di permission of 
EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY.

FOR YOUR ADVERT PLACEMENT CONTACT US

Copyright (C) 2020  Eagle Hedge Online News.

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.