NDDC don ask senator Peter Nwaoboshi to return N2.5bn of plastic chairs contracts.


NDDC don ask senator Peter  Nwaoboshi to return N2.5bn of plastic chairs contract.

By princess Eigbokhan Orih.
Breaking news.
Di Niger Delta Development Commission (NDDC) don asked Peter Nwaoboshi, chairman of the senate committee on NDDC, to refund di sum of N2.5 billion wey him collect to supply plastic chairs for primary to secondary schools for some area for Niger Delta.

Na Godswill Akpabio, minister of Niger Delta affairs,mention di name of  Nwaoboshi as one of the lawmakers wey  benefit from di contracts wey NDDC award.

Una still remember say that time wey Akpabio bi sit done for hot seat before the committe wey dey touch light for the corruption wey don chopp NDDC finish insist say make Akpabio mention the names of di law makers wey him claim say collect contracts from NDDC, na so oga Peter Nwaoboshi name take show.

NDDC still yan many many other contracts wey Nwaoboshi use fake company name take collect from dem hand and unto still oga Peter no still execute di contracts wey him collect on top.

As di Nigeria people never still recover from di bad news and bad behavior wey dey come out from NDDC na so oga Peter hits back ooo, him denied di  11 companies wey NDDC alleged say Peter used for fake contracts.

Oga Peter warn say make NDDC stop this National embarrassment say as di  CHAIRMAN,  say him no get hand put for the companies wey NDDC say  him used take  contracts for the Niger Delta Development Commission, NDDC.


He yan say  no one inside  all the 11 companies wey dey inside di list belong to him as far as di records at the Corporate Affairs Commission, CAC dey concerned. 

Make una no forget say di  NDDC spokesperson, Charles Odili on Sunday,  alleged say Senator Nwaoboshi used 11 different companies to fronts to secure for himself N3.6billion in September 2016.

Odili allegation no hold break as he further say inside di statement say the contract na hin bi  the “biggest single case of looting for the Commission’s resources.

“On this note,  Senator Nwaoboshi don challenges NDDC to allow independent investigation of all contract awarded by the commission and see if breeze no go blow foul yash open and di whole country go see say na Akpabio bi the greatest beneficiary of contract awards and looter of the commission.”

If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471, 
(+234)09011708783
 
Whatsapp: 
(+234)09012543471, (+234)09011708783, 

Email: eaglehedge16@gmail.com

For your advert placement call:
(+234)09012543471, 
(+234)09011708783


EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY
All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, written or distributed in full or in part, without di permission of 
EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY.

PRINCESS EIGBOKHAN ORIH
View all posts by Princess Eigbokhan Orih.

NEXT ARTICLE
Home
NEWS SPORTS ENTERTAINMENT VIDEOS RELATIONSHIPS POLITICS FORUM CONTACT US ADVERTISE WITH US PRIVACY POLICY
Copyright (C) 2020  Eagle Hedge Online News


Comments

  1. N2.5bn ehn?! Chai!! On top say make e provide plastic chair for we children dem. I dey very sure e no even do the contract sef. The thunder wey go strike these thieving leaders dey do press up.

    ReplyDelete

Post a Comment

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.