NO WAHALA DEY BETWEEN ME PLUS TINUBU: .......... AKEREDOLU

NO WAHALA DEY BETWEEN ME PLUS TINUBU: ....... AKEREDOLU


BY: ORIH MICHAEL CHINAEMEREM


Ondo State Governor, Arakunrin  OluwaRotimi Odunayo Akeredolu SAN don finally chuk mouth for Di matter into say people dey talk say gbege dey between him plus APC National Leader Bola Tinubu.

E get some rumors wey dey make people reason say Bola Tinubu no dey support make Akeredolu come back as Ondo governor. Na him bi why e come bi like say Tinubu dey support another aspirant, wey him name bi Segun Abraham before dem do APC primary elections.

But as Di matter bi now, dem disqualify Segun Abraham sake of say him get university certificate issues.
But for one program ontop Channels Television wey dem dey call Sunrise Daily on Wednesday, Akeredolu talk say all dis things wey we dey hear na lie. Infact na bad belle people wey one make him plus Bola Tinubu get serious gbege. 
Akeredolu talk say no gbege dey between him and Tinubu. In short him plus jagaban be like bread and butter.
As Di Stori dey go, Akeredolu talk say Di gbege wey happen between him plus him Deputy Governor, wey him name bi Agboola Ajayi, him say na  over-ambition and greed wey Di deputy governor get bi Di Koko of Di matter.

 governor Akeredolu talk say na  Agboola Ajayi decide say him wan leave  APC by himself but him go like advice Agboola say make him try copy better people wey bi  likes deputy governor of Edo State, Philip Shuaibu, or Vice President Yemi Osinbajo, wey dey  loyal to their ogas.
Meanwhile Governor Akeredolu, don clear everybodi say e too sure for am say him go win for Di  October 10 governorship election for ondo state.


If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471, 
(+234)09011708783
 
Whatsapp: 
(+234)09012543471, (+234)09011708783, 

Email: eaglehedge16@gmail.com

For your advert placement call:
(+234)09012543471, 
(+234)09011708783


EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY
All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, rewrite or distribute in full or in part, without di permission of 
EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY.

FOR YOUR ADVERT PLACEMENT CONTACT US

Copyright (C) 2020  Eagle Hedge Online News.

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.