PASTOR CHRIS OYAKHILOME TELL NIGERIAN GOVERNMENT "NO TRY REGULATE GOD'S PEOPLE

PASTOR CHRIS OYAKHILOME TELL NIGERIAN GOVERNMENT "NO TRY REGULATE GOD'S PEOPLE


BY ORIH MICHAEL CHINAEMEREM


Di overall oga for Christ Embassy, Pastor Chris Oyakhilome don shout give Nigerian Government say make dem no try am at all to reduce Di time wey people fit spend for church on Sunday service.

Pastor Chris Oyakhilome Yan say government no get right at all to dey put rules and regulations ontop church plus come still dey put timetable ontop how long services go take.
Pastor Chris Oyakhilome talk say make government  allow Christians make dem serve God anyhow wey dem want.
According to Pastor Chris, “We must to serve God Di way wey God want make we do am, no bi Di way wey somebody say make do am.

Pastor Chris Oyakhilome talk say him surprise say  some people get mind to dey tell us how many hours we fit to spend inside church. 
Chai!!! 
How dare you?
CALL 09012543471 TODAY AND ORDER FOR YOUR EXQUISITE AND QUALITY MALE SHOES. DELIVERY NATIONWIDE!!!



“Who Una bi self? Inshort Una dey drive ontop reserve tank. Una no fit tell children of God how long dem fit spend inside church. 

Unless say Na Una build Di church for us. But since say no bi Una build Di church for us, then make Una no try to even reason Di idea to tell God’s people say na one hour or two hours dem go spend inside church. 

Inshort na di number of hours una talk say we fit spend inside church, na dat same number of hours una get to live.”



Copyright (c) EAGLEHEDGE MULTIMEDIA COMPANY LIMITED 2020

FOR ADVERT PLACEMENT PLEASE CALL 09012543471 OR 08033207022
EMAIL US ON: eaglehedge16@gmail.com

Comments

Post a Comment

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.