PDP DON DIE......: JIMOH IBRAHIM

PDP DON DIE......: JIMOH IBRAHIM


BY: ORIH MICHAEL CHINAEMEREM


E don happen cos Di Stori no bi small suntin. Una don hear say Baba Olowo Jimoh Ibrahim don join All Progressive Congress APC  for Ondo state.
 
As jimoh Ibrahim dey join APC for lgbotako Okitipupa council area for ondo state, jimoh lbrahim talk say PDP don die. 
Him say na him take him hand revive PDP when PDP wan die and him go use Di same strategy take kill PDP for Di governorship election wey dey come so.

Di people wey dey for the place wen jimoh Ibrahim join APC na former Governor of Borno state, Senator Ali Modu Sheriff, ondo state governor Rotimi Akeredolu,  APC ONDO state chairman, Ade Adetimehin plus plenty plenty chieftains of APC.

Jimoh Ibrahim still talk say  if PDP candidate Eyitayo Jegede SAN like, make him use all him power plus Di one wey him borrow join, him go still lose Di election give Governor  Akeredolu.
Jimoh talk say, as him don join APC come collect broom for party chairman hand, in short PDP don die

MeanWhile jimoh Ibrahim say him no wan talk about  Zenith Labour Party (ZLP), because him know say as dem pack dem selves like serial betrayers Feng, dem no fit to do nothing.

Him say e pain am because person like Agboola go see golden opportunity come  miss am like player wey throwaway penalty come go  join  betrayers geng.  

Jimoh Ibrahim say Mimiko na man wey dem know as bad guy for long and him sabi  betrayal him guys plus political associates.
Jimoh Ibrahim talk say na because Governor Akeredolu don try well well for ondo state, especially as Akeredolu take rescue Olusegun Agagu University of Science and Technology wey Mimiko administration abandon for eight years.

Anyway, Di ondo state APC Chairman, Engr. Ade Adetimehin talk say for APC na only people wey get sense, leaders wey get integrity plus better character dey there and na him bi Di thing wey attract jimoh Ibrahim come APC.

 If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471, 
(+234)09011708783
 
Whatsapp: 
(+234)09012543471, (+234)09011708783, 

Email: eaglehedge16@gmail.com

For your advert placement call:
(+234)09012543471, 
(+234)09011708783


EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY
All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, rewrite or distribute in full or in part, without di permission of 
EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY.

FOR YOUR ADVERT PLACEMENT CONTACT US

Copyright (C) 2020  Eagle Hedge Online News.

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.