Adams Oshiomhole, Involved In Accident but Two Policemen die.

 Adams Oshiomhole, Involved In Accident but Two Policemen die.


Una hear say Two policemen have die and some other people injure for inside Di accident wey Di convoy of former National Chairman of  All Progressives Congress, Adams Oshiomhole, along  Benin bye-pass for Edo State.


We hear say one truck run come Jam Di convoy of Adams OSHIOMOLE wen him been dey go political rally for Usen, Ovia South-East Local Government Area.

We hear say na by luck Oshiomhole take escape Di accident.

Meanwhile Governorship candidate of APC for Edo state, Osagie Ize-Iyamu, talk say Di accident bi like wetin dem plan onto say dem wan kill Oshiomhole.

As Di matter bi so, Iyamu don talk say him don suspend all him activities.
Ize Iyamu say, him dey condole with Di families plus friends, and everybodi wey know policemen wey die for Di tragic accident wey happen to Comrade Adams Oshiomhole and other APC leaders  web dem dey go campaign for Usen, Ovia South East LGA.

Iyamu talk say Di accident dey somehow somehow because according to people wey dey there as in say e bi like Di truck wey cause Di accident do am on purpose.
But as Di matter dey police hand, ize Iyamu dey tell all him followers say make dem calm down make police finish work first.
 
 If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471, 
(+234)09011708783
 
Whatsapp: 
(+234)09012543471, (+234)09011708783, 

Email: eaglehedge16@gmail.com

For your advert placement call:
(+234)09012543471, 
(+234)09011708783


EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY
All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, rewrite or distribute in full or in part, without di permission of 
EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY.

FOR YOUR ADVERT PLACEMENT CONTACT US

Copyright (C) 2020  Eagle Hedge Online News.



 

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.