Ekiti APC Crisis: Fayemi Don talk how m own: Him say suspension na joke
By: ORIH MICHAEL CHINAEMEREM
As di suspension Mata dey hot, Ekiti State Governor, Kayode Fayemi, don talk him own onto Di suspension wey some person inside Ekiti APC give am sake of say dem claim say him dey do anti-party activities.
FAYEMI talk him own with Di mouth of him Chief Press Secretary Mr Yinka Oyebode.
As Di Mata bi, Fayemi talk say wetin did people dem do, na too much over play play.
Oyebode talk say All Progressives Congress (APC) na party wey get laws wey every member dey follow and dis people wey announce Di suspension no even get power to talk that Kain tin because all Di people wey sign Di wuru wuru suspension bi executive members of APC for any level.
So everything wey did people do na over play play dey worry dem because even Di people wey sign dis thing self dey on suspension and Governor Fayemi, no get any shaking because of Di wuru wuru tin wey some suspended members dey do.
Oyebode talk say make everybody plus members of APC no listen to wetin did people dey talk. Infact say wetin dem talk no dey make brain at all.
Him talk say Dr Kayode Fayemi still bi Di only of APC inside Ekiti State.
Di Ekiti State APC Chairman, Paul Omotoso, don also talk say wetin did group do bi like comedy.
Di APC Ekiti state chairman talk dis one with Di mouth of Director of Media, Sam Oluwalana. Di Chairman don tell all Di person wey sign Di tin ( Senator Tony Adeniyi, Senator Babafemi Ojudu, Senator Dayo Adeyeye, Congressman Bimbo Daramola, Hon. Robinson Ajiboye, Hon. Oye Ojo, Hon. Dr Adewale Ominrin, Hon. Femi Adeleye) make dem deny Di publication sharp sharp.
Comments
Post a Comment