Provost for Delta State College Of Education Use N36m Take Build Two Toilets

Provost for Delta State College Of Education Use N36m Take Build Two Toilets


BY ORIH MICHAEL CHINAEMEREM

E bi like say Di provost for Delta State College of Education Warri, Mrs Mary Edema don enter one Kain kurukere gbege.


Ontop tatafo tinz, we hear say Di provost, use N36m take build two toilets for inside institution.  
One senior staff for the school wey no wan make anybody know who him bi, talk say di two toilets wey dem build, say na mago mago way Di provost with di contractors, wey do Di job take conclude Di matter.
Him talk say di provost don already finish work with di contractors before she present Di project for bidding process. 
Him say As Di matter bi so, Warri College of Education don dey get bad bad name sake of say dem don dey sabi Di school as place wey like kurukere, mago mago plus thief thief things.
Him still talk say Di matter don worse.  even if person raise alarm, nobody go anything because di whole system dey corrupt. Those wey supposed take action no go even cough put for Di case because they don settle dem finish.
For one memo wey di reference number biTETF/ES/COE/AL.2017/VOL.XVII, na N17, 135, 871 dem take build each toilet and N2,593,459 na for consultancy.

 Awaguma Nigeria Limited plus Henag Nigeria Limited, na di two companies wey dem talk say Di college provost bring, wey later handle di  projects, wey dem call “Construction of modern lavatory for male and female students block ‘A and B".
Another person for inside Di school talk say Di money for Di projects, na part of di N75m “intervention fund” wey TETFUND give di college.

As dis matter reach Di ear of provost Mrs Edema, she talk say onto Di projects, say she no do any mago mago because she follow due process.

She say, Personal project dey different from public projects and she follow due process. 
 If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471, 
(+234)09011708783
 
Whatsapp: 
(+234)09012543471, (+234)09011708783, 

Email: eaglehedge16@gmail.com

For your advert placement call:
(+234)09012543471, 
(+234)09011708783


EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY
All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, rewrite or distribute in full or in part, without di permission of 
EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY.

FOR YOUR ADVERT PLACEMENT CONTACT US

Copyright (C) 2020  Eagle Hedge Online News.



 

Comments

Popular posts from this blog

OWING A HOUSE AT EVER BRIGHT HOMES FIFE GARDENS IS AN ASSURANCE FOR PEACE OF MIND.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE COMMENCES SALE OF FIFE GARDENS.

EVER BRIGHT DEVELOPERS AND REAL ESTATE MAKING STATEMENT WITH REAL ESTATE IN ONDO STATE NIGERIA.