Posts

Showing posts from September, 2020

Labour Don Call Off Strike, New Electricity Tariff Don Pause For Two Weeks.

Image
Labour Don Call Off Strike, New Electricity Tariff Don Pause For Two Weeks. BY: ORIH MICHAEL CHINAEMEREM Organised Labour, for early morning Monday 28th September 2020,  don press pause ontop suspended Di strike wey dem wan do sake of say government increase prices of petrol and electricity.  Dem agree to suspend Di strike inside communique wey labour leaders plus Di Federal Government representatives sign. Na Minister of Labour and Employment, Senator Chris Ngige read Di whole story give everybody, at di end of Di seven hours meeting.  Di matter inside wetin dem sign bi say, “everybody don agree to set up Technical Committee wey Ministries, Departments, Agencies, NLC and TUC, go together work for two weeks, from Monday, September 28.  “di job wey di committee get na to check why we need Di increment policy, meters, plus other many many tins. “people wey dey inside Di Technical Committee na: Mr Festus Keyamo(SAN), Minister of State Labour & Employment, Chairman; Mr Godw

Ekiti APC Crisis: Fayemi Don talk how m own: Him say suspension na joke

Image
Ekiti APC Crisis: Fayemi Don talk how m own: Him say suspension na joke By: ORIH MICHAEL CHINAEMEREM As di suspension Mata dey hot, Ekiti State Governor, Kayode Fayemi, don talk him own onto Di suspension wey some person inside Ekiti APC give am sake of say dem claim say him dey do anti-party activities. FAYEMI talk him own with Di mouth of him Chief Press Secretary Mr Yinka Oyebode. As Di Mata bi, Fayemi talk say wetin did people dem do, na too much over play play. Oyebode talk say All Progressives Congress (APC) na party wey get laws wey every member dey follow and dis people wey announce Di suspension no even get power to talk that Kain tin because all Di people wey sign Di wuru wuru suspension bi executive members of APC for any level. So everything wey did people do na over play play dey worry dem because even Di people wey sign dis thing self dey on suspension and Governor Fayemi, no get any shaking because of Di wuru wuru tin wey some suspended members dey do. Oyebod

APC DON SUSPEND EKITI STATE GOVERNOR FAYEMI

Image
APC Don Suspend Ekiti Governor, Fayemi BY: ORIH MICHAEL CHINAEMEREM   Di Ekiti State Executive Committee for All Progressives Congress don suspended Governor Kayode Fayemi. Na as we hear am ontop Channels TV na so we dey bring am give Una. Di Ekiti State Executive Committee for All Progressives Congress on Friday talk say Di reason wey dem take dey suspend  governor fayemi na because of him many many anti-party activities, especially Di one wey him do for Edo state governorship election . Dem everything wey him do dey contrary to di provisions for inside Article 21 (A) (ii) of APC constitution”. APC ekiti state dey talk say Governor Fayemi go host Mr Femi Fani- Kayode wey bi PDP member for inside ekiti state, Government House for Ado Ekiti. This one happen when dem dey prepare go Edo elections. APC ekiti state still talk say Governor fayemi follow for Di reason wey make APC loose Governorship election for Oyo State. This na because Governor fayemi go dey support PDP.

GBEGE HAPPEN FOR INSIDE OBASEKI POLLING UNIT

Image
Edo decides. NO BE SMALL GBEGE HAPPEN FOR GOVERNOR OBASEKI POLLING UNIT

EDO GOVERNORSHIP ELECTION. OSHIOMHOLE PRAY BEFORE HIM CAST HIM VOTE (WATCH VIDEO)

Image
 WATCH VIDEO ABOVE. OSHIOMHOLE PRAY BEFORE HIM CAST HIM VOTE UNIT 001, WARD10, IYAMHO, ETSAKO WEST LGA.

EDO STATE GOVERNORSHIP ELECTION. IZE IYAMU DON CAST HIM VOTE.

Image
APC GOVERNORSHIP CANDIDATE IZE IYAMU DON CAST HIM VOTE FOR IGUODODO WARD 5, UNIT 26, INSIDE ORHIOMWON LOCAL GOVERNMENT FOR EDO STATE.

LAGOS PALAVA (LEGALIZED AGBERO)

Image
You can not believe what just happened in Lagos state. Click below to watch video .   If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471,  (+234)09011708783   Whatsapp:  (+234)09012543471, (+234)09011708783,  Email: eaglehedge16@gmail.com For your advert placement call: (+234)09012543471,  (+234)09011708783 EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, rewrite or distribute in full or in part, without di permission of  EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY. FOR YOUR ADVERT PLACEMENT CONTACT US Copyright (C) 2020  Eagle Hedge Online News.

Provost for Delta State College Of Education Use N36m Take Build Two Toilets

Image
Provost for Delta State College Of Education Use N36m Take Build Two Toilets BY ORIH MICHAEL CHINAEMEREM E bi like say Di provost for Delta State College of Education Warri, Mrs Mary Edema don enter one Kain kurukere gbege. Ontop tatafo tinz, we hear say Di provost, use N36m take build two toilets for inside institution.   One senior staff for the school wey no wan make anybody know who him bi, talk say di two toilets wey dem build, say na mago mago way Di provost with di contractors, wey do Di job take conclude Di matter. Him talk say di provost don already finish work with di contractors before she present Di project for bidding process.  Him say As Di matter bi so, Warri College of Education don dey get bad bad name sake of say dem don dey sabi Di school as place wey like kurukere, mago mago plus thief thief things. Him still talk say Di matter don worse.  even if person raise alarm, nobody go anythi

ONDO STATE GOVERNORSHIP ELECTION. ONDO STATE WORKERS ENJOYS REGULAR SALARIES UNDER AKEREDOLU.

Image
ONDO STATE GOVERNORSHIP ELECTION. ONDO STATE WORKERS ENJOYS REGULAR SALARIES UNDER AKEREDOLU.  Click above to watch video

Adams Oshiomhole, Involved In Accident but Two Policemen die.

Image
  Adams Oshiomhole, Involved In Accident but Two Policemen die. Una hear say Two policemen have die and some other people injure for inside Di accident wey Di convoy of former National Chairman of  All Progressives Congress, Adams Oshiomhole, along  Benin bye-pass for Edo State. We hear say one truck run come Jam Di convoy of Adams OSHIOMOLE wen him been dey go political rally for Usen, Ovia South-East Local Government Area. We hear say na by luck Oshiomhole take escape Di accident. Meanwhile Governorship candidate of APC for Edo state, Osagie Ize-Iyamu, talk say Di accident bi like wetin dem plan onto say dem wan kill Oshiomhole. As Di matter bi so, Iyamu don talk say him don suspend all him activities. Ize Iyamu say, him dey condole with Di families plus friends, and everybodi wey know policemen wey die for Di tragic accident wey happen to Comrade Adams Oshiomhole and other APC leaders  web dem dey go campaign for Usen, Ovia South East LGA.