Posts

Ibadan Suspected Serial Killer don take off for inside Police Custody

Image
Ibadan Suspected Serial Killer don take off for inside Police Custody BY ORIH MICHAEL CHINAEMEREM E don happen ooooo! Everybodi come hear oooo! Oyo State Police Command Don tell everybodi say one bros wey him name bi Sunday Shodipe, wey police dey suspect say him job na to dey kill kill people anyhow,  don escape. Police talk say dis bros way no pure. As per say e get as him waka take join body with some ritual kill kill of people for Akinyele area for Ibadan, Oyo State. Joe Nwachukwu Enwonwu, wey bi di Commissioner of Police for Oyo state, Yan dis one with Di mouth of him talk talk person wey him name bi Olugbenga Fadeyi. Di Commissioner of Police, Oyo State Command, CP. Joe Nwachukwu Enwonwu, talk say, him wan tell everybodi say day bros wey dem torchlight as prime suspect for Di kill kill for Akinyele Local Government Area, Moniya Ibadan, wey him name bi Sunday Shodipe. The commissioner talk say Sunday Shodipe wey dem arrest plus two o

Ireland wan deport €5.5m Abacha money to Nigeria

Image
Ireland wan deport €5.5m Abacha money to Nigeria. By ORIH MICHAEL CHINAEMEREM Ireland government don agree plus sign MoU with Nigeria say dem wan repatriate €5.5 million. money wey abacha use control number plus mago mago carry comot from obodo Nigeria. Na di Department of Justice and Equality talk dis one on Thursday 13th August 2020. Una see dis money, na part of  di $5billion  wey  General Sani Abacha, thief for 1993 and 1998. Madam Helen McEntee, wey bi Di Minister for Justice and Equality, talk say she dey happy as she , sign Di MoU with Nigeria because dis one mean say after all di torchlight wey Criminal Assets Bureau follow join body do.  Wey open dem eye come see $1bn wey bi equal to €5.5 million inside one bank account for Dublin and wey also bi part of Di money wey General Sani Abacha theif.  MeanWhile for October 2014, Nigerian government send letter give Ireland government say make dem try send us Di money.  Na him bi why for 2019 High C

President Buhari’s Daughter, Hanan, go soon marry Special adviser to Fashola

Image
President Buhari’s Daughter, Hanan, go soon marry Special adviser to Fashola  BY ORIH MICHAEL CHINAEMEREM one of di pikin of President Muhammadu Buhari, don package finish. Dis girl wey her name bi Hanan, don gree say she go marry Mohammed Turad. Mohammed Turad na di special adviser to  Lagos State governor before before wey also bi Minister of Works, Babatunde Fashola SAN. As Di matter bi, Di marriage suppose happen on di September 4, 2020. make clear Una say Mohammed Turad na di son of Alhaji Mahmud Sani Sha’aban.  Alhaji Mahmud Sani Sha’aban na senator wey been represent Zaria for House of Representatives from May 2003 to May 2007. Alhaji Mahmud Sani Sha’aban na also ACTION CONGRESS OF NIGERIA (ACN) governorship candidate before before for Kaduna State. Una remember say, once upon a time, Aisha Buhari, been go Dubai,  inside Mohammed Indimi private jet.  Aisha BUHARI enter Dubai sake of say, she wan go buy fine fine things wey dem go use for her d

Governor Samuel Orton say make Naija citizens carry AK-47, defend boko haram

Image
Governor Samuel Orton say make Naija citizens carry AK-47, defend book haram. Published August 12, 2020.        ‌Princess Eigbokhan Orih Benue State Governor, Samuel Ortom, don yan say make Federal Government allow responsible citizens to protect themselves with weapons like AK-47 rifles as part of the ways to stop boko haram for we country. Orton yan this matter for the virtual meeting wey happen yesterday by Centre for Values in Leadership, CVL, in collaboration with Nigeria Governors’ Forum, NGF.  the Governor yan say governments for  all levels must come and agree with the matter of insecurity wey dey happen for we country. “He also recommend plenty money to fund the security agencies and training of we personnel so that they go fit handle all the bad people wey be bandits, book haram etc. “The Governor beg Federal Government make them embrace ranching as dem dey do it  for outside Naija and to make law to end open grazing

ROTIMI AMAECHI NEGOTIATES THE SALE OF NIGERIA

Image
 ROTIMI AMAECHI NEGOTIATES THE SALE OF NIGERIA  If you get Tori wey you wan make we help you share, send us SMS on (+234)09012543471,  (+234)09011708783   Whatsapp:  (+234)09012543471, (+234)09011708783,  Email: eaglehedge16@gmail.com For your advert placement call: (+234)09012543471,  (+234)09011708783 EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY All rights dey reserved. This material and any other digital content wey dey for  this platform make you no reproduced, published, broadcast, written or distributed in full or in part, without di permission of  EAGLE HEDGE MULTI MEDIA COMPANY. PRINCESS EIGBOKHAN ORIH View all posts by Princess Eigbokhan Orih. NEXT ARTICLE Home NEWS SPORTS ENTERTAINMENT VIDEOS RELATIONSHIPS POLITICS FORUM CONTACT US ADVERTISE WITH US PRIVACY POLICY Copyright (C) 2020  Eagle Hedge multimedia company limited

Governor Obaseki Order Edo state house of Assembly Roofs removed

Image
Govnor Godwin Obaseki don accuse police, Adams Oshiomhole, Hope Uzodinma of plans to 'take over hin government'. By Princess Eigbokhan Orih. Govnor Godwin Obaseki order di removal of  di roof of Edo State House of Assembly make nobodi do sitting again  afta di govnor kwanta wit police people wey attempt to take over di house of Assembly Complex. All dis gbege happen after president Buhari endorse Osagie Ize-Iyamu for Edo election wey dey happen next month. Before govnor Obaseki order di contractors to turn di Assembly complex to renovation project site, e bin don pursue police officers wey bin take over di building of di Edo State House of Assembly wey dey di state capital, Benin City. Di Special Adviser to di Govnor ontop Media and Communication Strategy matter, Crusoe Osagie wey bin follow Eagle Hegde News tok on behalf of di Govnor, accuse Oshiomhole heavy accuse say na im dey behind di attempt to take over government from Obasrki. Oga Osh

NDDC don ask senator Peter Nwaoboshi to return N2.5bn of plastic chairs contracts.

Image
NDDC don ask senator Peter  Nwaoboshi to return N2.5bn of plastic chairs contract. By princess Eigbokhan Orih. Breaking news. Di Niger Delta Development Commission (NDDC) don asked Peter Nwaoboshi, chairman of the senate committee on NDDC, to refund di sum of N2.5 billion wey him collect to supply plastic chairs for primary to secondary schools for some area for Niger Delta. Na Godswill Akpabio, minister of Niger Delta affairs,mention di name of  Nwaoboshi as one of the lawmakers wey  benefit from di contracts wey NDDC award. Una still remember say that time wey Akpabio bi sit done for hot seat before the committe wey dey touch light for the corruption wey don chopp NDDC finish insist say make Akpabio mention the names of di law makers wey him claim say collect contracts from NDDC, na so oga Peter Nwaoboshi name take show. NDDC still yan many many other contracts wey Nwaoboshi use fake company name take collect from dem hand and unto still oga Peter no still execute di cont